ICJ ruling on Israel-Gaza war: Jerusalem vow to continue wit Rafah offensive - BBC News Pidgin (2024)

Wia dis foto come from, Getty Images

Israel don vow to ignore di order from di International Court of Justice (ICJ) to stop dia offensive for Rafah, or oda operations in Gaza.

Di ICJ bin rule say Israel gatz stop dia military offensive and oda actions on Gaza immediately, as dem cite di "immediate risk" to di Palestinian pipo.

Judge Salam on Friday, 24 May tok say di ICJ di current situation dia get further risks of irreparable harm to di rights of pipo wey dey for Gaza.

E tok say di situation don change since di ICJ made im previous orders and dem don meet conditions for new emergency measures in di case.

Di court order Israel to report to dem within one month on dia progress in applying di measures wey dem order today.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

As a reminder, while ICJ rulings dey legally binding, in practice dem dey unenforceable by di court.

Israeli goment tok-tok pesin David Mencer tell di BBC say: "No power dey for di world wey go push us to commit a public suicide, becos dis na wetin e be, to stop our war against Hamas."

Di Palestinian Authority (PA) - wey dey run parts of di occupied West Bank - and Hamas - wey dey run Gaza and wey bin attack nearby Israeli communities on 7 October, sparking di current war - don welcome di decision.

However, Hamas tok say di call to end di offensive gatz cova all of Gaza and not just Rafah.

Di ruling "represent one international consensus to end di war on di Gaza Strip," PA presidential tok-tok pesin Nabil Abu Rudeina tell Reuters news agency.

Israeli war cabinet minister Benny Gantz tok say Israel go carry on wit dia "just and necessary" war against Hamas to return dia hostages and ensure dia security.

E tok say Israeli military go operate in accordance wit international law and try to avoid harming civilians.

"Di State of Israel dey committed to continue to dey fight to return dia hostages and promise dia security of dia citizens - wherever and whenever necessary - including for Rafah," e tok for one statement.

Di court orders

  • Orders by di court include say make Israel stop military operation for Rafah
  • Open di Rafah border crossing wit Egypt for di entry of humanitarian aid at scale
  • Ensure access to Gaza for investigators and fact-finding missions
  • Report to di court within a month on dia progress in applying dis measures

Judge Salam also speak about di situation of Israeli hostages wey Hamas still dey hold for Gaza.

"Di court expresses grave concern ova di fate of di hostages... and call for dia immediate and unconditional release," e tell di court.

  • Wetin be di impact of recognising Palestine as state - who don approve and who remain?
  • Hamas agree to ceasefire afta Israel say Rafah attack go happun no mata any deal
  • Wetin be Turkey own for di Israel-Hamas war and why dem stop business wit Israel ?

"We find am deeply troubling say many still remain for captivity," e add.

South Africa president quote Mandela as e welcome ruling

Wia dis foto come from, Getty Images

During one campaign walkabout near Nelson Mandela home for Soweto, President Cyril Ramaphosa quote di late leader: "We no go dey completely free until di pipo of Palestine dey free."

Former President Mandela na ardent proponent of Palestinian nationhood. Ramaphosa tok say Mandela bin teach South Africans about di connection wit Palestinians.

"A lack of justice for Palestine na also lack of justice for South Africa," e tok.

Foreign ministry chief Zane Dangor describe di ruling as "groundbreaking", and refer to di fact say na di first time di court make clear order to Israel to stop dia actions in a part of Gaza.

"We hope di UN Security Council take note of dis," e tok, and add say South Africa go approach di UNSC wit di order.

As a reminder, na South Africa bring di original case bifor di ICJ wey lead to today provisional measures.

Strikes hit Rafah camp minutes after ICJ ruling

Minutes afta di decision of di International Court of Justice, warplanes launch a series of air strikes on di Shaboura camp in di centre of di city of Rafah.

One local activist at nearby Kuwait Hospital tell di BBC say di sounds of bombing bin dey terrifying and clouds of black smoke hang ova buildings for di Shaboura camp.

Dem tok say di rescue teams for di hospital bin dey unable to reach di site of di raids sake of di intensity of di strikes.

ICJ ruling on Israel-Gaza war: Jerusalem vow to continue wit Rafah offensive - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Duane Harber

Last Updated:

Views: 6077

Rating: 4 / 5 (71 voted)

Reviews: 86% of readers found this page helpful

Author information

Name: Duane Harber

Birthday: 1999-10-17

Address: Apt. 404 9899 Magnolia Roads, Port Royceville, ID 78186

Phone: +186911129794335

Job: Human Hospitality Planner

Hobby: Listening to music, Orienteering, Knapping, Dance, Mountain biking, Fishing, Pottery

Introduction: My name is Duane Harber, I am a modern, clever, handsome, fair, agreeable, inexpensive, beautiful person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.